Christian Malanga: Who be leader of di failed coup for DR Congo wey involve im son Marcel Malanga - BBC News Pidgin (2024)

Christian Malanga: Who be leader of di failed coup for DR Congo wey involve im son Marcel Malanga - BBC News Pidgin (1)

Wia dis foto come from, Marcel Malanga/Instagram

Attempt to ovathrow di goment of di Democratic Republic of Congo in di last few days don further cause tension in di central African kontri.

Brig Gen Sylvain Ekenge, DR Congo army tok-tok pesin on 19 May say several armed men attack di office of di president, and second attack take place nearby for di house of Vital Kamerhe, former chief of staff and close ally to di current head of state.

Following di attack, dem don arrest 50 pipo including three US citizens.

Many initially believe say di attempted coup come from group of Congolese soldiers wey dey linked to di presidential guard.

However, dem later confam say na opposition figure Christian Malanga carry out di move, long-time critic of President Felix Tshisekedi.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

  • Gabon coup: Di latest for many military takeovers for di continent

  • All you need know about Democratic Republic of Congo 2023 presidential elections

  • DR Congo President Felix Tshisekedi don win re-election

  • Four presidential candidates call for cancellation of DR Congo elections

End of Recommended articles

Di army confam say dem shoot Malanga dead for di presidential palace afta e resist arrest by di security forces.

Dem last see am alive on Sunday morning via livestream on social media platform Facebook, as e dey stand alongside several heavily armed pipo wey dey wear military uniforms.

‘Felix, you dey go out. We dey come for you’, Malanga tok, as e confam im intention to ovathrow President Tshisekedi regime.

Malanga wey dey stand next to im pikin Marcel – security forces don arrest am - Malanga tell viewers for French, English and Lingala, say di military don ‘tire’ and ‘ dem no fit march togada' wit Kamerhe and Tshisekedi.

Who is Christian Malanga

Christian Malanga na 41 year-old-man wey dem born for Kinshasa on 2 February 1983.

Im papa na Joseph Itedjo Malanga from di Mangai Village and im mama na Christine Kapayi for Kinshasa.

At age five, e lose im mama, and im papa later remarry Chantal Kibonge Malanga. Christian Malanga na di oldest of six pikin of her late father.

Malanga bin live for Swaziland at di age of 15-year-old as political refugees in 1993 and later move to Salt Lake City, Utah, in 1998 as refugee.

E later return to Congo for 2006 as military captain afta e co-founder one non-profit called Africa Helpline Society for di same year.

Malanga run as parliament in 2011 but dem arrest am two days bifor di poll. E exile imsef to US for 2012 to acquire American citizenship.

For 2017, e create goment for exile in Brussels, name di New Zaire, wey im wan restore sovereignty to di Congolese people.

E proclaim im sef as president of di United Congolese Party (UPC), as he claim to dey fight for prosperous and safe new DRC.

Dis na national political party wey e form afta im experience during di 2011 parliamentary elections.

Malanga dey successful for both business and politics until e die on Sunday, 19 May 2024 wen e bin lead failed coup against di goment of Felix Tshisekedi for Congo for di Palais de la Nation.

Christian Malanga na former Congolese military officer wey dey live for di United States wit im family.

Malanga campaign on religious freedom and dem appoint am as di first ambassador of di International Roundtable on Religious Freedom for 2013.

Christian Malanga dey popular for im hostile videos against di regime of president Félix Tshisekedi from di USA, wia im bin dey base bifor dis attack on di president.

Christian Malanga: Who be leader of di failed coup for DR Congo wey involve im son Marcel Malanga - BBC News Pidgin (2)

Wia dis foto come from, Marcel Malanga/Facebook

Christian Malanga na di papa of 21 year-old Marcel Malanga and seven oda pikin wey im born wit Lucile Malanga

Marcel Malanga also wey follow im papa go for di failed coup on Sunday.

E bon Marcel for 2003 and e don spend all in life for Utah, as e dey active ontop im social media as e bin dey post fotos of im lifestyle.

Afta Christian Malanga move to USA, e attend Highland High School. As e graduate from High School, e start small businesses for Africa.

Christian Malanga and im family non-profit organization adopt ova 20 children wey dem support dia education for Africa.

Im political journey start wen e join di military for Congo e lead troops against di Mai-Mai rebel group. That is when he witnessed a vast effects of government corruption.

US Ambassador to di Democratic Republic of Congo, Lucy Tamlyn on X tok say she dey shock by reports say US citizens allegedly dey involved in coup attempt.

Félix Tshisekedi don be president of DR Congo since 2019

‘Rest assure dat we go cooperate wit di DR Congo authorities di fullest extent possible as dem dey investigate dis criminal acts and hold accountable any US citizen wey dey involve’, di diplomat tok.

President Tshisekedi neva tok anytin to di public on di attack.

Dem re-electe am last December for im second-term in office, 20 die pipo becos of election-related violence wey happun.

For April, dem appoint economist Judith Tuluka as prime minister, she be di kontri first woman to hold di role. But Ms Tuluka neva appoint her goment.

DR Congo na kontri wey dey rich in natural resources and wit estimated population of more dan 100 million pipo. But di kontri dey face prolonged violent conflict in di east, economic and social crises, and ongoing lack of trust between di goment and opposition.

Dis coup attempt don cause concern, as di continent don dey rock by six coups d’état since 2020: two for Mali, two for Burkina Faso and one for Guinea and Niger respectively.

Christian Malanga: Who be leader of di failed coup for DR Congo wey involve im son Marcel Malanga - BBC News Pidgin (2024)
Top Articles
Latest Posts
Article information

Author: Roderick King

Last Updated:

Views: 5951

Rating: 4 / 5 (51 voted)

Reviews: 90% of readers found this page helpful

Author information

Name: Roderick King

Birthday: 1997-10-09

Address: 3782 Madge Knoll, East Dudley, MA 63913

Phone: +2521695290067

Job: Customer Sales Coordinator

Hobby: Gunsmithing, Embroidery, Parkour, Kitesurfing, Rock climbing, Sand art, Beekeeping

Introduction: My name is Roderick King, I am a cute, splendid, excited, perfect, gentle, funny, vivacious person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.